+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Jaguda Boys Don Bomb APP Secretariat For Rivers

Dem say na nite wey pipo dey sleep nai tiff dey waka nai be di case wey hapun for Rivers State, Port Harcourt as some bad guys go destroy APP seke.

Around 1 on Monday morning nai pipo just hear sound for GRA side where Action Peoples Party seke dey, naso everybodi wake up from sleep.

Di jaguda boys use dynamite take fall di building unto plenty tok tok wey dey fly upadan say Govinor Siminalayi Fubara dey wan run go APP party.

As morning reach na pipo see window, celling and tins wey don scatter for di seketaria building and some members of APP sat na bad belle politicians dey use folow di party cus he don dey grow weight for di state.

Di tokpesin of River State Command, Grace Iringe-Koko, say she never know about di mata but go do more finding.

Know say since Govinor Fubura take over power from Nyesom Wike naso dem twi don turn cat and rat wey nor dey see eye to eye for Rivers State.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM