+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rwanda New Presido Go Stay Till 2034

Di ceremony wey dem use take out Rwanda Presido, Paul Kagame, make he dey again for seat na on Sunday and naso he dey back chest to always support he kontri.

Di Presido na 66 years now and don dey for leadership position since afta di civil war wey Rwanda fight for 1994 between demsef and Kegame go stay as Presido til 2034.

Pipo don dey bad mouth Kagame from inside and outside but he nor dey shake with all di blasting and don even ban two opposition pesin nor to contest for any big position for di kontri.

As he don enta seat again, international communities don dey shine dem eye and touch for he bodi dey look as human right law dey play for di nation as anoda term dey kwatinue for ome man hand.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM