+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Give $1M To Okpebholo First, E Fit Come Arise TV– APC

Na 1m dollars nai APC Campaign Council tok say dem go kolet for dem candidate for Edo, Monday Okpebholo, to go do interview for Arise TV station.

Na on Monday nai di New Media Campaign team of di party say make nor bodi feel say Okpebholo dey fear to go tok for interview, na just say him get to choose which one go beta.

All dis one start afta Adams Oshimole go interview for Arise TV and Rufai Oseni come dey ask am he stand with di party candidate but Oshimole dey use Kona mouth take dey tok.

While for Okpebholo side since he turn APC candidate he never gree tok to any news pesin about he plan for di state.

Na all of di mata come make APC for Edo say if Arise TV bodi dey do dem to interview Senator Okpebholo, make dem pay am $1 million them maybe he fit think am again.Cus Okpebholo nor go fit karey hesef go where pipo go dey use am play.

Even PDP don bin accuse APC say dem nor get anytin to offer cus tins don already cast for dem inside di kontri.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM