+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Subsidy Dey Abei E Nor Dey? NNPCL Tok Deir Side

Too much tok nai dey for fuel mata onto say Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Ltd say dem dey sell fuel for half di price wey dem take dey bring am enta kontri.

Some kind documents bin fly wey show say subsidy still dey go on for Nigeria but Nigeria govimet come out say na lie notin like that dey shele.

Even di foma Govinor of Kaduna State, Nasir El-rufai, bin tok say di moni wey Nigeria dey spend for subsidy now big pass wetin dem dey spend bifor, but dem still troway di tok for one side.

For press briefing on Monday, nai di Chief Financial Officer (CFO) of NNPC, Abuba Umar Ajiya, tell NAN say nor be subsidy NNPCL dey pay na sumtin wey dem call shortfall.

Ajiya say na N7.8 trillion naira nai e cost Nigeria to pay for dis shortfall only from January to July 2024, know say fuel price na N600.

He come say NNPCL only dey epp FG take care of di shortfall for petrol importation.

Wetin subsidy means selling be say you go dey sell wetin you buy for a mouth wey nor reach how you take but am and one official communication wey TheCable bin don see between NNPCL and Presido dem remove subsidy come use shortfall take replace am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM