+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Two Mpox Nai Don Land Rivers State

Dem don dey shout since make Nigeria pipo dey careful as monkey pox don come back again dey spread like wild fire and 39 cases nai dem don confam for Nigeria already.

For Rivers State alone na two case of Mpox nai dem just confam according to Dr Adaeze Oreh wey be di State Commissioner of Health.

On Tuesday for Port Harcourt back she take tok di two case for news conference and she tok say dem don do Public Health Emergency Operations Centre wey go sharply ansa any emergency for Mpox mata.

Oreh tok say Govinor Siminalayi Fubura don put tins in place make dem find out and trace place wey di Mpox don waka enta and even train workers wey go epp monitor cases and know how to go about di case since di disease dey very dangerous.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM