+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

If Una Try Arrest NLC Presido, Darkness Go Cover Everywhere — NUEE Threaten FG

Afta police don send invitation to Comrade Joe Ajearo, di Nigerian Labour Congress Presido to come ansa kwestun about terrorism and other bad tins, National Union of Electricity Employees, NUEE, don sag if police try am say dem arrest Ajearo nai be say na darkness nai di whole kontri go see.

Na for statement wey NUEE bring nai dem take para folow Intelligence Response Team, IRT of Nigerian police say na nonsense behavior nai dem dey do .

NUEE’s Acting General Seketary, Igwebike Dominic, police just dey behave like small pikin Wey nor get sense and even FG sef dey dance like mumude dey follow.

He say di way police take invite Comrade Ajaero you go see say na witches and wizards work in place as from federal govimet and dem nor fi sitdon cross hand dey look.

Dominic come say FG never even tok about how police karey dem too left leg go NLC headkwatas go karey documents wey nor bodi dey office, and FG sef nor even fot say sorry but dem start to point finger of accusations.

So statement come say, pipo don already bin dey vex for FG Bifor but dis one just dey show clearly like satelight dem mind for kontri men even with policies wey dey favour only dem pocket.

Even sef bifor NUEE statement, Ajaero don bin use he lawyer reply IRT say na 29th of August he fit come dem office.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM