+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We no say make naija piple no chop bread – NAFDAC

NAFDAC, the agency wen dey regulate food and drug for naija don come out say dem no say make Naija piple no chop bread.

NAFDAC south-west coordinator Roseline Ajayi bin talk say many bread wen dey market no pass unto lab test mata and say some producers dey use saccharine sake of say sugar price high.

She yarn say “our eye no blind for the way the economy be but the agency no go come down for e standard. E dey important to take note say we no go compromise for the quality and safety of products”

Based on this yarnings, one reporter come do video put for Ajayi post dey tell naija piple make dem no chop bread.

The NAFDAC DG, Mojisola Adeyeye wen she dey talk con say the video no follow for wetin Ajayi talk.

“E no get the time wen NAFDAC tell Nigerians say make dem avoid bread wen dem bake and dey sell for Naija. NAFDAC no join wetin the reporter talk for that video wen dey flow for social media. This one na the personal yarnings of that reporter and e no dey speak for NAFDAC….”

NAFDAC come warn bakers for Naija make dem no use food material wen dem no approve.

“Any baker wen we catch dey use food additive wen we no approve, for this case now, Saccharine, that person we go sanction am as awa regulations talk. The Nigerian Industrial Standard(NIS) sef no permit saccharine for bread…”

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM