+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

BBL Injection Don Kill Woman For Lagos

One nurse wey dey work with clinic wey dey do big nyash and breast enlargement for pipo don land for police net afta one 36 years woman l, Mrs Abiola die for dem hand on Monday.

Dem say Mrs Abiola dey stay for Diamond Estate for Sangotedo-Lekki, wey around 3:00 for on Monday morning tell her driver to karey her go di clinic for Lekki Phase 1 make she go take injection wey go epp make her nyash big.

Wetin di tokpesin of Lagos Command, Benjamin Hundeyin tok on Wednesday be say, na di driver nai come report di case for Maroko Police station on Tuesday.

As dem reach di clinic, dem tok with di owner wey say, na nurse nai e send to give di woman injection but as dem give Mrs Abiola finish, nai she start to shake like fish wey dem remove from water.

Di clinic come rush am to anoda clinic for Lekki Phase 1 wey dem see say water don dey pass garri, but na there dem take confam say she don kpeme.

Police right now don arrest nurses wey give injection, snap di dead bodi and other tins wey dem go take use for investigation.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM