+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NNPC Nor Know How To Pay Fuel Moni

Na last week nai Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, tok say dem wan karey Warri and Kaduna Refinery give private owners so that na dem go dey in charge of tins cus be like eye dey turn dem (NNPC).

On Sunday nite nai NNPCL confam say dem dey own too much gbese for pipo wey dey supply dem fuel and e come confam wetin don dey waka since say NNPCL get one or two for dem cupboard.

Di company say even if tins dey be one kind dem mind still tanda to make sure say dem follow wetin PIA Act tok and supply fuel for di kontri.

But that one nor mean say dem go press dem neck die, so make govimet agencies, stakeholders wey go like put bodi come join hand to see steady supply for fuel.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM