+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dangote Refinery Don Produce Dem First Fuel

For di first time since dem build di Dangote Refinery for Ibeju-Lekki, Lagos State, dem just produce dem first fuel wey Nigeria fit use for dem daily business.

Na di Oga kpatakpata wey be Aliko Dangote nai bring sample of di fuel dey show di whole world today for Lagos State.

As Dangote dey tok for di 650,000 capacity refinery, he come dey greet Presido Tinubu govimet as dem take stand encourage am plus with di policy of say dem go now dey sell crude with naira wey go epp boost di naira.

Nai oga Dangote come say di refinery go fit meet di demand of Nigeria pipo and other African kontris wey dey around.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM