+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New Petrol Price Press Pipo Neck For Nigeria

Pipo wey dey stay for different states for Nigeria don dey shout for di way tins take dey be base on fuel price mata as prices of food go just high pass di way e don already be bifor.

Drivers and passengers for Akwa-Ibom, Kaduna, and other states nor komot from di problem as many dey queue for filling station make dem fit get fuel while some stations sef nor even open.

Bifor one liter of fuel na N617 but s e dey now na N897 per liter nai NNPCL retail management dey sell not to tok of di high price for from black market.

On Wednesday for Akwa-Ibom normal transport with keke from Plaza to Four Lane, Oron Road, wey be N200 bifor dem don dey karey am for N500.

Even for Kaduna Keke wey dey go from central market to Sabo bin dey for N300 but now if you nor pay N500 o.y.o go be your case as everybodi dey shout for di new brand of shege banza.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM