+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Awa Presido Nor Sleep Cell Dis Nite If Una Want Peace— NLC

As e be say DSS don arrest Comrade Joe Ajearo wey be Nigeria Labour Congress Presido, di union dey provoke say Federal Govimet don shuk hand for dem eye and if govimet nor free dem Presido anytin wey dem see make dem take.

For sharp meeting wey di National Administrative Council organize today, di Deputy Presido of NLC, Prince Adewale Adeyanju, come bring statement say di Federal Govimet take arrest Ajearo just be like say di man na tiff and na just bad sign of Presido Bola Tinubu govimet nai dem do so.

Dem even come still put mouth for di high price of fuel mata and say make govimet reduce di price and bifor day go dark reach 12 for nite today Monday, if Ajearo never come out, di story nor go be shoot bird e mama fly leave am again.

Di union come say di National Executive Council, NEC, go gada tomorrow morning by 9 make dem tok on di next step wey dem go take concerning di mata wey dey ground.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM