+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New tenant don gbes with neighbours children for Osun state

One new tenant don vanish with neighbor two children for the Igando area of Ilesa, Osun State.

According to report, the tenant tiff the children, wen be four and two years old, after she don clean her one-room apartment finish for one ‘face-me-and-face-you’ building wen dey for around the Cele area of Igando on Saturday.

According to the report, the tenant pay N6,000 for six months’ accommodation give one of the old tenants for the house.

The mama of one of the children wen dey miss, Funke Komolafe, say the lady dodge comot from the house den she come lie say she dey carry the girls dey go buy something when neighbours when take see her dey leave with them.

When d mama of the second pikin Itunu Joseph come dey explain wetin happen, she come talk say dem get three buildings wen dey share one backyard. She say the woman meet dem dey wash their clothes on Saturday morning and say her two-year-old daughter been dey play with her mates for inside the building where the lady for take rent one room.

She say after the new tenant don clean her room finish, she come pretend say she gets belle and say she don tire, na so she come sit down for the backyard dey play with the children. She say the new tenant come even tell her sef say she like her daughter in particular and say she dey wish to get pikin like her.”

Joseph say d lady come stay with dem for about three hours before she come enter inside her room. As she enter her room, na so the children follow her, but say dem no notice when she take leave. The people for the front of the house come see her wen she dey wake dey comot with the children and na so dem come ask her where she dey go. She come claim say she dey go buy something for them around. She waka with them reach the junction, where she for come take enter okada.

Joseph say when she no see her daughter, she say people around come tell her day na the new tenant nia carry her pikin and neighbour pikin comot.

As God take do am, dem know the okada rider, but he say after he drop d lady, na so she and the children come enter another okada wen dey wait for the Adeti area of Ilesa. She say dem don search for children, but dem never still find them yet.”

The mama wen dey worried and confused come tell news people on Wednesday, say the lady dey between 17 and 20 years, she fair and she dey carry low haircut and nails wen she fix.

She say the lady no tell dem her name

When news people come ask her how the lady take pay for the rent, Joseph come explain say na one tenant for the house nia collect the money and den tell the landlord. The landlord come if she know the woman, the tenant say she knows am. The landlord come approve the rent without giving receipt.”

Like dis, dem don report the case give the police and the Osun State Amotekun Corps.

Meanwhile, the state corps Commander, Adekunle Omoyele wen confirm the matter come talk say dem dey aware of the situation, and say dem dey work hard to locate the woman.

Omoyele come talk say by God’s grace, dem go find her and the children.”

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM