+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dangote and NNPC Get Coma About Fuel Price

Pipo don dey happy say laslas fuel go yakpa as Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, go karey petrol for Dangote Refinery on September 15, 2024. But be like di small Kleg dey base on how much NNPC take wan dey buy.

Na yesterday nai NNPCL and Dangote start to tok again say nor be N898 per liter be di price of fuel as NNPCL tok say na that amount dem take buy.

Dangote come say di price nor be di real price as dis product wey dem get na di one wey dem bin don buy with dollars from obodo oyibo.

For statement nai Dangote tok thru di mouth of di Group’s Chief Branding and Communications Officer, Anthony Chiejina, say wetin NNPCL say na N898 dem buy fuel na just to put malice and tok for pipo mouth.

Dem come say make Nigerian pipo nor fear cus Presido Bola Tinubu don bin put Technical Sub Committee wey go put di price of fuel and na by October 1, 2024 nai dem go put price base on crude wey dem sale to refinery with Nigeria moni.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM