+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Actor Plan Justice Protest To Lagos Assembly Cus Of Mohbad death

Dem don dey call Youths and pipo wey di tin dey pain for bodi to come out come do peaceful protest on Monday September 30 to get justice for Ilerioluwa Aloba wey do die.

Na Nigeria film actor Yomi Fabiyi wey be still human right pesin nai dey drum dis protest from Instagram.

He say na Lagos State House of Assembly nai dem go waka go cus do way pipo wey dem hand dey for Mohbad death dey spend millions to make sure say dem cover evidence about di poor boy death nor good and Lagos State Govimet get set up committee to investigate.

Do actor say normally for di house wey Mohbad dey state get CCTV camera, wetin dey stop police to go check di camera nai he never know.

Fabiyi day make Lagos rep dem do sumtin so that pipo wey dey keep kwayet nor go come karey law put for hand as di case nor dey funny again.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM