+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Sama New Case Of N110b Against Yahaya Bello

New 16 count charges nai Federal Govimet don samakwe give di foma Govinor of Kogi State, Yahaya Bello, and di moni reach N110 billion.

Know saye bifor dis new case EFCC bin don charge Bello N80.2 billion for moni laundering wey he tiff and karey govimet cash take dey chop life for Nigeria and Dubai with he broda/sista children wey Ali Bello, Dauda Sulimam, and Abdusalam Hudu.

Dis new charges of N110 billion wey EFCC karey go Federal High Court for Abuja dem say na base on criminal breach if trust.

While oga Bello on he own bim don drag EFCC to Supreme Court say dem dey declare am wanted like say hin na tiff.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM