+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Dey Think To Kill Mysef— Bobrisky Cry Out

Popular boy wey dey dress like woman Idris Okuneye aka Bobrisky say di N15m wey dem tok say he go pay EFCC dey make head turn.

For he Facebook page nai Bobrisky take say since dem born am he never think to kill hesef once but as he dey now, wetin he dey resin na how to die.

He say human being just wicked and na how to bring pipo down nai dem dey think about cus you nor like di pesin. Even pictures and videos for Instagram he don delete all.

Wetin he write be say he nor need any bodi to pity am cus na only he mama and papa wey don die fit pity am. But if you dey think say friends go fight for you, then you don lost.

Know say na Vincent Martins Otse aka VeryDarkMan nai drag Bobrisky come outside say he pay huge moni to EFCC to drop moni laundering charges against am and even call Falz and he papa name, Femi Falana say dem try to get am presidential pardon from prison.

Cus of wetin VDM bring out nai make even di House of Rep say dem don set up ad-hoc committee to investigate EFCC and Nigerian Prison Service to know di truth.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM