+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Invite University Don To Ansa Mata Ontop Terrorism Charge For Uwheru

University Don, Patrick Muoboghare, nai Delta state police command dey accuse of terrorism, gun running cartel, hard drug selling plus other yamayama tins.

Patrick na di Presido General of Uwheru Kingdom for Ughelli North LGA, and police under X-Squad Unit say maje he and some community leaders like Chief Macpherson Igbedi, Mr Obukohwo Ekpevwru, karey demsef report to dem headkwata for Asaba.

Na by 11’Oclock dis morning nai di letter say make Muoboghare wey be foma Commissioner for Higher Education, reach di office with di other suspect wey police don already dey investigate bifor.

Assistant Commissioner of Police, Lucky Adagbon wey dey in charge of di X-Squad Unit nai sign di letter.

Even one pesin inside di community confam di letter and say di way di problem dey smell e be like na from di gbege wey dey between di traditional ruler for Uwheru Kingdom and some of di leaders for di community.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM