+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govimet Say No Big Celebration For Independence Day

As October 1 independence day celebration dey come and hunger wey dey kpokpo di whole kontri, Govimet don say dem nor go do big celebration while youths say dem go enta street protest.

Di year na di second time wey di administration of Presido Bola Tinubu say dem nor wan do big celebration for October first as shege banza dey tear for pipo eye even with di N70k new minimum wage increase.

Wetin Senator George Akume, Secretary to Govimet of di Federation, he say why Presido say make dem nor tear gbedu for di October independence, na cus ginger dey beat pipo and di govimet dey sorry for di ordinary kontri man.

Even as govimet don say dem nor wan do big party for di Independence Day celebration, some activists wey dem bodi nor for rest for di mata say dem go karey protest enta street cus tins don too much and don pass garri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM