+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Hold Your Dog and Cat If You Nor Wan Enta Prison For Six Months — Oyo Govimet

With di Dog Law of 2019 wey don already bin dey for Oyo State, pipo wey get dogs and cats di state govimet don tell dem to dey always give dem animal injection make dem nor dey give human being rabies.

Na through di Commisoner for Agriculture and Rural Development, Olaleye Olasunkanmi, nai di govimet take tok so for Ibadan, say make pipo dey give vaccine to dem cat and dog.

Dem say any pesin wey get cat or dog and never go visit veterinary clinic make he do so fast bifor govimet hand go touch am as do spread of disease from animals to human being too much.

Nai Olasunkanmi come still say dem nor wan see any dog or cat dey waka anyhow for street without di owner by di side and any pesin wey go against dis 2019 law na
N250,000 e go pay, or go six months for jail or if e too much na di two punishment di pesin go face.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM