+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Presido Don Japa For Yearly Vacation To Obodo UK

Presido Bola Ahmed Tinubu today range he load wey he wan karey go stay for obodo UK for two weeks base on say na so he dey do every year.

Na di Special Adviser to the Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga nai announce tok di mata.

Di statement say make pipo nor think say na just chop and sleep nai Presido go dey do for UK, cus na work he go still dey work and even dey think and make move on how he administration go fit beta di life of kontri men dem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM