+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Woman Buy New Born Baby For N2m, Keke Man Save Baby

Police don arrest one Lauretta Akomen for Warri, Delta State, afta she go buy baby of teree days from one native place wey dem take dey born for Port Harcourt Rivers State.

For October 1, 2024, nai one keke man wey four women hire to karey dem for Warri, start to hear how di women dey tok about tins wey concern di baby wey dem karey.

As di driver hear am, afta two of di women come down nai di keke man change location karey di other two women drop for Ekpan police station.

Wey police come dey ask di woman, nai Akomen say dem give her some medicine make she take for di native clinic afta some time she come be like who get belle, na dem come tell her when di baby go ready make she come kolet am.

According to SP Bright Edafe, Police Public Relations Officer for Delta State Command, he tok on Friday say na N2m nai di woman take buy do pikin and dem don dey do investigation afta e finish na straight to court.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM