+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Di Resin I Make My Pikin First Lady For Akwa-Ibom, Gov Umo Eno

As di First Lady for Akwa-Ibom State, Mrs Patience Umo Eno just die all of a sudden di husband wey be Govinor Umo Eno don give di First Lady work to dem first dauta Mrs Helen Obareki.

Pipo start to chop mouth for di mata why Govinor Eno go karey First Lady position give he pikin wey di deputy govinor wife dey alive.

But di Govinor don explain di resin wey make am do wetin hin do. He say first of all na Senior Special Assistant, SSA and Coordinator of di First Lady Office nai he give Mrs Helen Obareki so that she fit continue with di work wey her mama bin dey do bifor she die.

Pastor Eno come use example from bible of Peter tok, say hin know say normally dem nor dey appoint First Ladies but with di way tins come be na Mrs Obareki nai dey close to do mama and sabi tins wey di mama don put in place , so e do dey good make she epp complete am so that di projects nor go die.

So as Mrs Obareki dey take di role for office make no bodi think say ma politics mata but na just base on di experiences wey she get and know about get mama project and intiatives.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM