+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Komot Form Rivers State LGAs Wey Close Down Bifor

To follow tins di right way di 23 LGA wey police bin lock for Rivers State, di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, don say make dem open di Secretariat.

Nai di State Commissioner of Police, Bala Mustapha, thru hin di state tokpesin, Grace Iringe-Koko, bring statement on Monday hours afta Govinor Siminalayi Fubura don swear in di LG chairmen wey pipo vote on Saturday.

Na for July nai police take close di 23 local govimet headkwata for Rivers state afta gbege come out say di chairmen don stay pass dem time and nor wan komot.

Since di election don come and go l, e dey right now for di policemen to komot from di premises as dem bin dey there as hold di place down bifor.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM