+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Papa Of Nine Kill Sef For Jeddo Cus Of Wife

On Monday, October 7, 2024, wey pipo dey say new week don start nor be so for Mr Charles wey dey stay for Jeddo community for Okpe LGA, as he karey otapiapia drink die.

Dis man na pesin wey don born 9 children and na vigilante nai be he work for Jeddo but pipo say dem hear wey hin and di wife dey quarrel and Charles come dey beg di wife make she nor park leave am but di wife nor gree.

Tins come get kleg afta Charles drink otapiapia for he house for Jeddo finish nai he karey hesef go he in-law place for Ugbokodo, come die there.

As pipo dey surprise wetin hapun, wey dem dey check am, na only di otapiapia empty bottle dem see for he pocket.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM