+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fear As Sapele Pipo Shurkin Cus Of Explosion Sound

Panic full Sapele on Tuesday nite afta explosion just burst for Mission road one side wey dem take dey keep condemn iron, kill one pesin and wound some

Na around 6 for evening mak pipo wey see say di tin take hapun afta one of di iron condemn boys karey wetin fit bomb enta di site.

Di pesin wey die, dem say he bodi finish for di blast and di other two pesin wey wound dey still take treatment.

Whole one senior police man say he never get di right to tok with media pipo, say wetin dem dey suspect na either gas cylinder or fire extinguisher cylinder wey one of di iron condemn karey enta di place and nor know how di tin be nai cus di blast but dem dey do investigation for di mata.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM