+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pikin Wey NDLEA Shoot For Eye, Dem Don Run Leave Am — Family

Afta over one year wey National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, shoot small Eromonsele Omhonria and he broda Ivan wey be two years die, as dem dey their mama shop.

That time Eromonsele na just one year for July 2023, wey NDLEA bullet touch he eye and afta di first treatment di agency don run leave dem.

Na wey di papa and mama of di small boy go House Committee join with dem lawyer and representative of NDLEA, nai dem take dey tok how NDLEA dey misbehave since.

Fidelis Omohoria say afta dem don try tire to get visa to travel to US as hospital tell dem to do but e nor fit work as NDLEA nor dey show bodi put for di mata to bring di right documents.

Wey Matthew Edaghese di family lawyer come dey tok, he say Eromonsele dey pass thru pain cus when he dey cry di tears dey mix with blood and not too long small glass fall from di eye.

Nai make dem dey sue NDLEA for N2 billion but di committee say that moni too much for NDLEA cus dem nor go fit pay but dem go sharply send two years Eromonsele go abroad for treatmen

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM