As Presido Bola Tinuba don bin say he go change some tins for di administration e don hapun as Sports Minister, John Enoh and Niger Delta Affairs Minister, Abubakar Momoh nor know where to stand again.
Tokpesin of President, Bayo Onanuga nai announce on Wednesday say Niger Delta Ministry and Ministry of Sports Development nor dey again afta dem close di ministries for Federal Executive Meeting, FEC, today for Abuja.
Na Ministry of Regional Development nai go dey now to control all di Regional Development Commissions wey bin dey. Then National Sports Commission nai go take over Ministry of Sports.
Dem come still say Ministry of Tourism don join with di Ministry of Culture and Creative Economy.