Alex Ikwechegh di House of Representative member wey from Abia State, don get many lamblaster from pipo afata he slap one Bolt driver, Abuwatseya, wey come deliver package, di driver come tell am to come outside to pick am na there he take vex, even say he go komot di driver from dis life and he nor get who wan epp am.
Laslas afta plenty tok and blasting, di politician don come out to beg di driver and Nigeria make dem nor vex for di kind behavior wey he display, as w nor good for pesin wey dey for public eye and cus of di behavior he go use am take dey train pipo on how to dey behave wey dem dey vex.
Ikwechegh say he nor like wetin he do Abuwatseya, di constituency wey he dey rep, and even di general public.
He come still thank Nigeria police as dem sharply enta di mata to make sure say nor politician yeye anybodi no mata who dem be.