Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don hold four men wey dey do wayo enta pipo bank hakant and even withdrawal without dem knowing afta infomat give tip about di men woruwuru ways.
Di leader of di group nai be Chima Anthony Nwigwe, then Effiong Victor Emmanuel, Damian Ali folow join and Mohammed Bello Mahmud, nai come be di Managing Director of Downstone Ultimate Limited.
Di work wey dis men dey do, na to dry hack bank systems, put some kind funny tins for database, do transfer and even withdrawal moni thru different platforms.
Wetin EFCC tokpesin, Dele Oyewale, come say in Tuesday be say, di men dey with dem and afta investigation na to enta court.