Federal High Court for Abuja don give order say all di monthly allocation from Central Bank of Nigeria wey dey go meet Rivers State, make dem stop am cus e get kleg.
On Wednesday wey Justice Joyce Abdulmalik dey give di jorjimet nai he take say di 2024 budget wey Govinor Siminalayi Fubara send to Rivers House of Assembly nor just folow di normal Nigeria constitution.
Di judge say how four-member panel go sitdon and approve allocations since January, but dem nor go sitdon allow that kind tin Kwatinue again.
Nai di judge say make CBN, Hakantant General of di Federation, Zenith, and Access Bank make dem nor allow di State Govinor take moni from di Revenue and di kontri Federation hakant.