Popular man wey dey behave like woman, Idris Okuneye aka Bobrisky, nai don reach Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) hand for kwestun and ansa as tortoise name wey nor dey komot from story.
Na for Murtala Mohammed Airport nai EFCC take catch Bobrisky yesterday, Thursday nite as he wan run from Nigeria go Amsterdam for obodo UK, nai dem drag am komot from di areoplane.
Wetin insiders from di Commission tok be say as dem catch Bobrisky yesterday for Lagos dem don fly am to Abuja make he go ansa case wey Senate and EFCC call am to ansa concerning di N15M wey he use take bribe some EFCC officials to take remove money laundering case for he head.
Bifor now di Director of Public Affairs, EFCC, Wilson Uwajaren, nai say Bobrisky nor suppose dey run upandan make he come prove di case of N15M wey he give EFCC cus if dem find out say na lie, that one na anoda new gbege.