+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Family Provoke Afta Police Give N100k To settle Death Of Woman For Nasarawa

Di families of Ashenenye wey dey stay for Nasarawa State, dey vex as dem pikin wey be 35 years die for police hand, then later police bring N100k make dem take do burial.

Patience Akla Ashenenye dey on top okada with her teree months pikin wey one Hilux van from govimet house jam dem for October 21, 2024, for back of Ta’al Conference Hotel, close to School of Health for Lafia.

As di accident hapun nai dem rush Ashenenye, her pikin and di okada man, Tasiu Mohammed to Federal University of Lafia Teaching Hospital, but afta 20 minutes nai di woman die.

Di broda of Mrs Patience, George Akube wey dey tok to Foundation for Investigative Journalism, FIJ, say two days afta di sista die, dem dey do wake keep when two DPO come say dem come greet di family with N100k to take epp dem.

Akube say dem reject di moni even his sista inlaw cus na justice nai dem want for dem own come join di small teree months boy wey still dey hospital dey take treatment for leg wey break.

Even di State Police Command PRO, Ramhan Nansel, say really di CP Umar Shehu send pipo to meet di family and give dem moni to epp reduce stress and still go pay for di other two wey dey hospital.

But he come say even di police officer wey jam dem still go police clinic for Lafia for treatment cus shock enta he bodi but afta dem discharge am nai he go greet di family. Say that one nor still stop di CO not to give justice for di death of Patience.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM