Afta M.D Abubakar wey dey epp represent di Attorney General of di Federation, put application make dem free di small #EndBadGovernance children wey police hold come karey go court, di Federal High Court for Abuja don free 119 of dem.
Dem put in for di case to cancel am and take over di mata wey dey bifor di judge of di court, Justice Obiora Egwuatu, and all come gree to stop di case against di children.
Di release dey come afta Presido Bola Tinubu tell di Attorney-General and law enforcement agency make dem sharply free di small children for prison.