Pipo wey dey stay Jalingo for Taraba State don dey beg di state govimet to call di chairman of Pure Water Producers Association and investigate wetin make water distribution companies for di state dey behave somehow.
All na sake of say pipo don tire to dey buy one pure water for N50 and di wahala don too much.
Dem say if dem compare di price for Jalingo to di one wey dey for Adamawa and Gombe where dem dey sell for a N20 or two for N50, di pipo say e reach make govimet come out mouth.
As dem dey shout say govimet nor get regulatory bodi to check mate wetin dey hapun for pure water factory, even di pure water pipo say na cus fuel price too high nai make material to produce am come still go up.