+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Mali Sack Prime Minister As He Tok Bad Of Govimet

Kontri of Mali don porchu Prime Minister, Choguel Kokalla Maïga, cus of wetin hin tok against di military govimet for di kontri during one rally wey dem do for Bamako, di kontri capital.

Maïga bin tok some days ago say why di junta govimet go shift when dem suppose do election for March 26 go date wey nor bodi even know afta dem take power from military since 2020.

On Wednesday nai Alfousseyni Diawara, wey be di Seketary General of President office, nai say di Prime Minister and members wey join am, make dem go house.

Maïga own be say di junta govimet and Military leader Assimi Goïta nor dey tell am anytin na just media he take dey hear tins.

Di govimet never tok who go take over from Maïga as Prime Minister.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM