+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Be Awa Men Dey Pack Fuel From Tanker Wey Fall — NPF

Di Nigeria Police Force don come out tok dey own side for di video wey dey trend as police officers dey pack fuel from tanker wey fall for road.

For statement wey Police tok on Monday for dem X handle thru dem Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi, nai say make pipo look well cus di uniform wey di policemen for di video wear resemble Nigeria own but nor be Nigeria police be that as na anoda language nai di men dey speak.

Police say if pipo put ear down dem go know say na French nai di officers dey speak but news just dey fly anyhow cus bad pipo wan use am take destroy Nigeria Police Force name.

Nai NPF say na neighbor kontri wey dey speak French police dey di video, so e go beta make pipo know sumtin Wella bifor dem come out tok about am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM