As Brazil don put law say dem wan dey protect Olosho workers di ones for Nigeria don dey shout say make dem still do law to protect dem for abuse and exploitation.
Na di National coordinator for Nigeria Sex Workers Association (NSWA), Amaka Enemo nai raise du concern of dem members on Tuesday say even police pipo, dem customers no treat dem well like human being.
Enemo say make govimet hear dem cry as Olosho work no be tiff, e good make pipo still value dem for di kontri.
Di Olosho coordinating madam say na as den even dey around nai make disease, infection and even HIV nor dey too spread.
Nai Enemo come dey beg govimet say make put tins in place to epp secure di life of all Olosho wey dey Nigeria.