Police for Akwa-Ibom State don arrest one David Nse Emmanuel wey dey produce gun join with him papa, Akpan Nse and brothers but di others run.
Mr Akpan Nse and hin children dey make guns and sell am give tiff and bad pipo inside Akwa-Ibom and outside di state until information come reach police about wetin dem dey do for di state.
Wey di Commissioner of Police for di State dey tok for di Command Headkwata for Ikot Akpan Abia, Uyo, CP Joseph O. Eribo, say as dem hear di mata naso dem rush go di place to raid am but hand only for touch one pesin.
Wetin dem seize for di place na seven new made single-barrel gun, five double-barrel gun, one special steel double-trigger pistol, one broken single-barrel gun, one trigger-handle walking stick knife, and many iron pipes wey dem dey use take dey make gun barrel.
Police right now dey find do others wey run and dey promise say dem go trace reach pipo wey dey come buy gun from di factory.