+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

E Betta Make You Change Your Name From Kemi, VP Shetimma Tell Kemi Badenoch

‎Vice Presido, Kashim Shetimma don say many pipo wey dey japa especially Nigerians dey epp obodo oyibo kontri economy beta.

‎All di plenty tok start wey VP Shetimma dey trow blow for Kemi Bandeco di new Conservative Party leader for UK, as she dey do wan kind dey shift bodi from Nigeria wey she come from.

‎Kemi bin don curse Nigeria leaders for 2022 say dem nor get sense as na only to dey tiff public moni dey use for dem sef nai dem sabi.

‎But on Monday for Abuja during di 10th Annual Migration Dialogue for State House, Shetimma congratulate Kemi but say he nor like di way she dey do, make she kukuma komot di Kemi from her name and face front.

‎Because afta Kemi enta position nai Nigeria Govimet thru di chairman of Nigerians in Diaspora Commission, NIDCOM, send message to Kemi office but till today di woman nor ansa Nigeria.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM