+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Warri Need New Look – Ovuozorie Macaulay

‎Di foma Seketary to Delta State govimet, Comrade Ovuozorie Macaulay, say make all di new govimet wey dey enta power dey always think of how to development Warri cus nai be di bubbling place of di state.

‎Na wey di foma labour leader wey still Serve as Honourable Commisoner for Inter-Ethnic Relations and Conflict Resolution dey tok for await radio nai he take tok so.

‎ Macaulay say any investment wey govimet put for Warri e worth am cus di city don bring beta development to do whole kontri.

‎But he nor come happy say wey foma Gov Ifeanyi Okowa give am position to work as di Director-General of Warri, Uvwie and Environs Development Agency, WUEDA, he nor fit work well cus moni nor dey to do di work, he come be like say di position na just to disgrace am, nai make am dey explain hinsef to pipo.

‎Maculay come thank foma Govinor James Ibori as he give am di opportunity to epp bring peace for di crisis wey dey Warri that time.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM