Dem don karey first position give Nigeria for bleaching cream wey men and women dey use and di govimet don dey try to make sure say dem tok to pipo about di danger of bleaching cream to make pipo stop.
For one regional awareness-raising workshop to komot lightening cosmetics products, wey Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Salako, take tok for Gabon, nai he take dey urge West African pipo to know di bad tin wey products wey get hydroquinone, mercury and other tins dey do for pipo bodi even cus cancer, skin problem and damage pesin organ.
But on Wednesday for Abuja, Dr. Salako, bodi come dey pepper am as he say pipo go even see wetin dem write put for those creams, ointments, soap, pills and injections but dem nor go still hear, dem go karey dey use especially women wey wan show dem men.
He come say Nigeria don dey do National Policy for Cosmetics to make sure say pipo wey dey wan use cosmetic products dey safe from all dis bad tins wey dey cus sicknes and disease for users life.