Case wey Stanley Okonmah file against President Tinubu and na lawyer Olukoya Ogungbeje nai karey am to Federal High Court say dem wan tell National Assembly to komot President Bola Tinubu for di role he play for di 2024 #Endbadgovernace protest, others don dey challenge am.
Na team of lawyers wey Sanusi Musa, SAN, Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Prince Lateef Fagbemi, SAN, and President Tinubu come say di case nor get any stand and no bodi right dey under ground.
President Tinubu and AGF say di pesin wey bring case come court just dey fight for pipo wey nor get face and dem nor even tok anytin like say govimet go against dem right but di man karey mata for head like who dey hawk.
Govimet say for di protest dem send security pipo to make citizens dey safe make jaguda boys nor go take over di process.
Di case na Justice James Omotosho.dey jorjimet am but on Monday, dem come karey am go March 4 so that di lawyer wey dey represent Stanley Okonmah, go fit ansa kwestun wey President Tinubu and AGF dey ask.