Popular singer, Innocent Idibia wey e family mata don dey waka for social media afta he say he don divorce him wife Annie Macaulay Idibia wey be he African queen, online inlaws go drag am tay cus new mata dey come up daily.
Afta 2face post wetin he post for social media, nai rumour start to waka say di singer dey follow one honorable member cus dem even see di two of dem for Lagos club.
But for video wey 2face just release, nai he dey confam say he dey friend Edo State lawmaker, Natasha Osawaru, dis one na afta video come out wey di singer go Edo State House of Assembly wey dem dey do meeting.
As e be now 2face don serious to marry Osawaru cus he say she fine and know book, so make pipo nor dey tok say na she be home breaker.
Di video he tag am “To Whom It May kwansighn. #I don yarn my truth. Feel free to kwatinue to tik anytin. We go all dey alright.
“I don dey see many tins, many pipo dey tok wetin dem nor know afta I lost wetin I post, yes na me post wetin I post.
“Una don dey drag Hon. Natasha enta di mata dey call her different kind of names even home destroyer.
“But di woman na just young pesin wey karey book for head and know wetin she want but nor get anytin to do with me and Annie marriage.
“Yes I love her, she dey amazing, she dey cool, I wan marry her.”