+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Woman Dokitor For Umuahia, Put Scent Leaf Inside Patient Womb

‎One Miriam Ugochi Emenike, wey lie say she be dokitor wey sabi anytin wey concern woman bodi for Umuahia, Abia State, nai world pipo don dey complain about say na fake and make health sector do tins to make am tight so that fake nor go dey again.

‎D karey Dr. Emenike go Federal High Court for Abuja as she dey play wayo to be dokitor for FMC Umuahia and one private hospital, Echoes of God’s Mercy and Grace Mission Specialist Hospital wey dey Umuahia.

‎Tori get am say dem employ Emenike as Medical Director for September 2023, but di pipo come dey notice say she nor sabi use dokitor language and she don even give wrong mericine wey cus miscarriage for one woman and make anoda one die plus that one dem dey see different tins for her certificate.

‎One pesin even say for one procedure wey dem do, na scent leaf wey dem dey chop nai Dr. Emenike use injection put for some patients bodi, say as dem wan do IVF di scent leaf go clean di womb.

‎As di admin staff don dey see so many kleg for di dokitor, dem tell di owner of hospital say di woman nor know wetin she dey do instead he promote am to be Chief Medical Director, naso pipo start to resign, write letter to di Medical and Dental Council of Nigeria.

‎Na there dem notice say Emenike name nor dey medical dokitor register and di nuba wey she dey use as dokitor na anoda dokitor get am.

‎Dem don karey di case go March 10, 2025, as pipo wey she don give wrong treatment plus dokitors and nurses go come tok wetin dem know against Emenike.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM