+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

‎I Don Come Start My Work Back, Obasa For Lagos State House of Assembly

‎Lagos State House of Assembly dey get many kwanta wey dey make di House shake cus of leadership position but on Thursday tins come turn anoda tin as di foma Speaker, Mudashiru Obasa come with plenty security to take over seat from Mojisola Meranda on Thursday.

‎Na for January 13 nai di House take porchu Obasa say make he nor be Speaker again cus he dey misbehave and dem come put Mojisola Meranda wey be di Deputy.

‎ But bifor dem know wetin dey hapun tori start to waka say President Bola Tinubu nor happy say dem remove Obasa put Meranda.

‎As tok dey go front and back on Thursday nai dem withdraw Meranda security details and give Obasa back he own security details.

‎Di foma speaker force hinsef enta di complex dis morning with policemen and different security pipo, push di speaker office door open say he don come start work and naso he supporters dey him back.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM