Senior Pastor of Trinity House, Pastor Ituah Ighodalo wey marry foma beauty queen Ibidunni Ighodalo wey don die, say he nor dey plan any wedding with actress Kate Henshaw.
Aproko start to dey waka for social media say di pastor dey plan marriage with Nollywood actress and pipo don even dey buy Aso-Ebi.
But for interview wey di pastorman do for Upgrade TV nai be say na big lie as he nor dey plan any marriage.
He say he love him late wife wey dem two adopt children togeda. dat since di wife die since 2020 her spirit still dey with am.
According to di pastor, “I love my wife well well. I just dey see everyday as e be. I nor know wetin dey front. For di Aso-Ebi, me I nor know. know say social media pipo get di way dem dey behave.”
Laslas, nai he say di pipo wey dey spread di news go dey make moni from am and wen dem don gada finish, make dem come he church come pay tithe.