Di national disgrace wey dey hapun for di National Assembly cus of say Senator Natasha Akpoti-Uduaghan nor gree change seat wey Senate President Godswill Akpabio tell am to change, she come say Akpabio dey tell her to share moimoi give am, Christian Association of Nigeria don say make dem know how to handle di mata.
Na di CAN chairman wey dey cover Northern States, Rev Joseph Hayab, on Tuesday nai tok for Kaduna say even though say di story against Akpabio dey shameful to tok for mouth but make dem use sense take bring peace enta di mata.
He say make pipo nor dey karey say make Akpabio komot from di position of Senate President as no evidence dey to show but make senior men and pipo wey get level put mouth cus di disgrace nor just good for National Assembly.
Still for di same mata, remember say Senate wan discipline Natasha thru dem Senate Committee on Ethics, Privileges and Public Petitions but now Federal High Court for say make dem nor do anytin like that against Natasha.
Na on Tuesday nai Justice, Obiora Egwuatu, give di order afta Natasha lawyers bring application.