Big Nigeria politician wey be di foma presidential tokpesin of Peter Obi campaign, Dr. Doyin Okupe na dem say don die fordi age of 72.
Amebo first dey waka early mormor say Okupe nor too well but later pipo wey dey close to di family come confam am.
Sources and associates for di family nai say di foma Director don dey fight cancer since but di sickness come overpower am, press am die.
Di time wey Okupe be di Director-General of Peter Obi Presidential Campaign Council he dey work well bifor court bring case say make he stop unto say dem tok say he dey tiff moni.