+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Dey Vex For Fubura, He Know Wetin Go Bring Peace —Wike

Foma Govinor of Rivers State wey be Minster of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, say he nor dey happy with wetin Govinor Siminalayi Fubara wey he hand over parwa to dey do for di state and even di letter wey he write to di State House of Assembly na just useless tin.

‎Fubura bin write letter thru di SSG, Tammy Danagogo to di lawmakers say dem want peace and even go bring di 2025 budget to discuss with Speaker Martin Amaewhule wey Supreme Court don already say make dem bring back.

‎Di tok nor sweet for Wike ear and even some of di lawmakers come block Fubura make he nor enta di Assembly, but wey Wike come dey tell tori pipo for Abuja, he say Fubura just dey do di lawmakers and Speaker like say dem be he pikin and nor get any single respect for dem.

‎Wike say Fubura know di right tin to do to bring peace as politician wey he be, cus normally he suppose call Amaewhule and he pipo to tok to dem privately nor be to dey write public letter wey nor make sense.

‎But for Fubura part, he don gree say he go follow wetin Supreme Court tok a don don tell di Rivers State Independent Electoral Commission make dem do anoda fresh LGA election for August 9, 2025.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM